TAH Lyrics
- Genre:Afropop
- Year of Release:2021
Lyrics
TAH - Prinx Emmanuel
...
Eh
Eh
Eh
Prinx Emmanuel
Brother Nwachukwu
Abeg o, don’t be sleeping on a bicycle
If dey say you no go make am, say na lie (Tah!)
Say you no go carry dollar maka why (Tah!)
Eh, they say you go suffer pass Job (Tah!)
And even if them tie you C-4 you no go blow (Tah!)
Bros, if dem say you no go make an say na lie (Tah!)
Say you no go charge phone for Dubai (Tah!)
Eh, they say you go suffer pass Job (Tah!)
Even if they tie you C-4 you no go blow (Tah!)
Bros make you tell dem say that one no be for your head
Oga make you tell dem say that one no be for your head.
As you see us so we no dey carry last (Eh!)
Na so so away you dey see, we no dey carry pass (we no dey carry pass)
Even if these people dey carry jazz
Dey go dobale when dey see us dey drive pass
In a convoy, very long convoy
Dem go say who be this one, where him don join?
Dem go clear road make we park well
When we dey shout we are made, no be house girl
Accelerate (accelerate), we dey accelerate
E go pepper dem when dey hear say we celebrate
Shey dey be write am we no go come first
But their paper go cut o, sure bet
If dey say you no go make am, say na lie (Tah!)
Say you no go camp house maka why (Tah!)
Eh, they say you go suffer pass Job (Tah!)
And even if them tie you C-4 you no go blow (Tah!)
If dem say you no go make an say na lie o (Tah!)
Say you no go charge phone for Dubai (Tah!)
Eh, they say you go suffer pass Job (Tah!)
& Even if they tie you C-4 you no go blow (Tah!)
Tell dem tell dem say that one no be for your head
Oga make you tell dem say that one no be for your head.
Dey say your market no go sell (Eheeh!)
Dey say your office no go pay (Story!)
Say hard luck go dey come your way
Even the people wey dey owe you dem no go pay
Dey say your poverty go loud like a mass choir
You go find job you go trek tire
Dey say your shoe don chop
But you wey dey wear d shoe you never chop
Eh God, they say you no go buy Mercedes
Say you go dey fly keke na pep on a daily (Eheeh!)
Dey say you no go but private jet
D people wey get am na two head dem get (Story!)
I want to pray for you o
Abeg every body say amen. Amen!
I want to pray for you right now abeg everybody say amen. Amen!
See, you go get money. Amen!
You go buy the land. Amen!
If you be importer, exporter your container go land. Amen!
Those people wey dey owe you tey tey, very soon dey go send alert. Amen!
You go pay school fees. Amen!
House rent go be chicken change. Amen!
Bros, you go pay Oga landlord, and you go tell am to keep the change. Amen!
Brother Nwachukwu
Abeg o, don’t be sleeping on a bicycle